HomeBlog. top nigerian blogbest bloggerBlogbond station suicidegistdotcominternal communicationslondonSisi YemmieCall Me Bond…

Call Me Bond…

Hello my lovely people,how market? (don’t mind me, just random, lol). So I have gist…story story…
Last Saturday I started a new course in Internal Communications (yay!) so  I had to go to London to take the class, when I reach there the tutor say make we introduce oursef, and he started with me-why oh why! I had that awkward moment where I didn’t know what to say…and then i went…*gulp*My name is yemi so&so, graduated in so&so, working as a kini at so&so for the past 3 months. I cleared my throat and siddoned.

 The next woman started with “my name is Mary, CEO so&so, 23 years in the Comms Industry”. Next dude, “hi, Alan, Director so&so, 15 years in the industry”…”Kim, Manager so&so enterprises for 25 years”…and na so all of them introduce demselves. My self esteem just drop …the work wey I dey do nor even relate to the course, dem kon dey wonder wetin I dey do there…lol. Even me I kon dey wonder…if no be me start the introduction I for don come up with something like….”CEO Gistdotcom, Manger so&so in Nigeria”…Oh well, nothing spoil. God dey.

On my back home, I was at bond station,holding my heavy textbooks, waiting for the train and thinking about my life when I noticed one black guy, he was well dressed with suitcase sef, like pesin wey just dey from office. Omoguy close eye, dey hum to music without earphones and he dey march. Odd I thought…but in this London nothing is odd-the weather too cold for krase man to pull cloth waka naked-their krase get level. So the omoguy kept marching and humming with eyes closed towards the platform…and I was looking…he was marching…I was looking and like joke na GBOINGGG!  I hear, omoguy fall inisde the train track and a train was approaching…

I dumped my bags, books plus the new shoe wey I buy and got into the tracks along with another man to help take him out, another lady helped too, the crowd just dey hala…’OMG’ WTF’…I thought to myself ‘na dat one we dey talk?…c’mon come and help use to carry this omoguy’…the guy just heavy like pesin wey chop 2 buckets of akpu. I dey use my corner eye dey spy my load wey I drop…I can’t shout. We carried him out just in time as the train approached.

What was weird tho, was that this omoguy dusted himself, carried his suitcase and stood as normal as if nothing happened…!!!The station officials finally arrived and I pointed…’that is the guy that fell in’…shuo, cos dem kon dey tink say na me or the other bros wey help naim fall. Abeg oh.. LOL. It was when I left the station I thought…Oh my! I just helped to save a man’s life and I began to feel cool, and my head began to swell, and swell, and swell…abeg make una help me hold am. lol

So from henceforth call me BOND…Yemmie BOND 

0 thoughts on “Call Me Bond…

  1. As you don turn Yemmie Bond, make I pose as the 'bond guy' small. As you know say James bond dey always get bond girls.
    That was a good deed. Reflex.

  2. LMAO. 3 GBOSA'S for Yemmie Bond. No let your self esteem drop o jare. After all, you be CEO of GistDotCom and other etchetaram etchetaram. That was a heroic thing you did in helping to save the guy. At some point, I thought you would say the guy was blind.

  3. Hahahaha, this is not funny but the way u narrated d whole story funny chai.
    Yemmie Bond, ur baptism name na im be dat. How person go close eye dey waka, smh.
    CEO gistdotcom I hail oh!!!

  4. OMG!!! JEsus Christ! Yemmie Bond, over-liver dey worry u o! Abi, the train tracks nor resemble the ones wey dey NYC?! Abi?..Cos if na the type wey dey for NYC, train dey come, pesin march inside, walai, I go join mouth in prayers make the rats wey dey on top the track carry am to safety ni…..Walai, over-liver and adrenalin boku for your body!

    By the way, is that you in the pinshure?! What m I saying? It has got to be u….vyn geh no pimples!

    As per the introduction thingy, I no even fit laugh u….u berra become paddies with those people. Na real gold mine for connections be that…

  5. LMFAO @ HoneyDame

    That was some serious bravery. IDK that i would have jumped in after him…maybe just help pull him up while still on the platform. Look at you, Yemmie Bond!

  6. O wow! Craziness get levels oh! *smh* yemmyBond toh bad lolz. Am glad God used u for him sha

    All d best with ur bus course, don't let ur classmates intimidiate u jore, u seem like d youngest there. Represent our generation wella. :*

  7. laughter has killed me. i think my contractions has started …….wow brave of you, jumping into the track to save the guy. And it seems like the guys sef no care say e nearly die.
    As per your class i can imagine how embarrassed you were. Just try and network with those people they are a good set of people to know one on one.

Leave a Reply to Unveilinggold Cancel reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

×