HomeBlog. top nigerian blogbest bloggerBlogbond station suicidegistdotcominternal communicationslondonSisi YemmieCall Me Bond…

Call Me Bond…

Hello my lovely people,how market? (don’t mind me, just random, lol). So I have gist…story story…
Last Saturday I started a new course in Internal Communications (yay!) so  I had to go to London to take the class, when I reach there the tutor say make we introduce oursef, and he started with me-why oh why! I had that awkward moment where I didn’t know what to say…and then i went…*gulp*My name is yemi so&so, graduated in so&so, working as a kini at so&so for the past 3 months. I cleared my throat and siddoned.

 The next woman started with “my name is Mary, CEO so&so, 23 years in the Comms Industry”. Next dude, “hi, Alan, Director so&so, 15 years in the industry”…”Kim, Manager so&so enterprises for 25 years”…and na so all of them introduce demselves. My self esteem just drop …the work wey I dey do nor even relate to the course, dem kon dey wonder wetin I dey do there…lol. Even me I kon dey wonder…if no be me start the introduction I for don come up with something like….”CEO Gistdotcom, Manger so&so in Nigeria”…Oh well, nothing spoil. God dey.

On my back home, I was at bond station,holding my heavy textbooks, waiting for the train and thinking about my life when I noticed one black guy, he was well dressed with suitcase sef, like pesin wey just dey from office. Omoguy close eye, dey hum to music without earphones and he dey march. Odd I thought…but in this London nothing is odd-the weather too cold for krase man to pull cloth waka naked-their krase get level. So the omoguy kept marching and humming with eyes closed towards the platform…and I was looking…he was marching…I was looking and like joke na GBOINGGG!  I hear, omoguy fall inisde the train track and a train was approaching…

I dumped my bags, books plus the new shoe wey I buy and got into the tracks along with another man to help take him out, another lady helped too, the crowd just dey hala…’OMG’ WTF’…I thought to myself ‘na dat one we dey talk?…c’mon come and help use to carry this omoguy’…the guy just heavy like pesin wey chop 2 buckets of akpu. I dey use my corner eye dey spy my load wey I drop…I can’t shout. We carried him out just in time as the train approached.

What was weird tho, was that this omoguy dusted himself, carried his suitcase and stood as normal as if nothing happened…!!!The station officials finally arrived and I pointed…’that is the guy that fell in’…shuo, cos dem kon dey tink say na me or the other bros wey help naim fall. Abeg oh.. LOL. It was when I left the station I thought…Oh my! I just helped to save a man’s life and I began to feel cool, and my head began to swell, and swell, and swell…abeg make una help me hold am. lol

So from henceforth call me BOND…Yemmie BOND 

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

×