Nor be small tin! I came home (Nigeria) for a short holiday and my blog-threns, what my eyes have seen so far….kai! I will start with this house-help gist. I met a girl when I came in, she has been working with my mom for about 2 weeks now, she comes in often to help out in cleaning the whole house, my parents are usually home by themselves and they have no energy or time to sweep all the rooms in the house. So my mom got this girl that comes once in a while to sweep, mop, wash dishes and GO! yes GO! But i don dey notice kpe e be like say Babym is trying to Yapa si wa l’orun! These are the signs I noticed:
1. She dey smile too much and laughs for no reason. I like staff that are happy working but abeg, hide that your seductive coy laughter somewhere. Oga ask you “Patience how are you”…and na so she go dey laugh life hyena wey dem totori (tickle)….erm, i dont like it, she gats to go!
2. She don turn the coriddor to her runway. She dey swing and sway around the house. Hmmm…I dont mind her walking, but swaying those okpelenge hips is giving me cause for worry. The way she dey twist ehn…Oluchi dem dey learn for their catwalk.
3. She don dey change cloth too much. New new designs, today na deep V-neck she go wear, 2moro na sweetheart neck she go nack, kon arrange all the bobby(boobs) dem well, she don dey wear only C-thru tops (Egbami oh!) the skirts kon dey short, the jeans don dey tight, i fear for her health cos she must be suffocating in those jeans!
4. She don dey hide things. My dad dashed her money twice because on those occassions she had to do extra mopping, washing and cleaning and said she should show Madam oh. Omobabe did not. Madam confronted her and she gave that coy seductive smile and said…”i forget”.Hian! Na so e dey start!Mbanu!
5. Her hairstyles don too current and flexible sef. She go do Rihanna, Beyonce, Boys follow me. Make-up gan don pass House of Tara abi na House of Ayamtanga or Karashika.
6. She came in today with perfume! This is the end of Omobabe in this house. I don tell am make she no come again, Biko her services are no longer needed. Na from clap e dey enter dance!Its goodbye. One has to be careful with these helps, especially the ones that live-in withyou. You have to be very observant…and shine your eye before water go pass garri.
Na-who-give-Ekaette-belle is not our portion!!! Amen!
On the other hand, Hamzat the hausa gateman is a nice boy, he is learnng a word of English per week. This week was Thank you. All he ever says to me is “Abinchi” (food) and Thank you. And smiles. lol. All wedo is sign language….my hands are tired from gesticulating wildly. Only if he had an education….sigh. I will encourage him to learn a trade or do something more than just gate keeping.
Question time: Would you prefer a househelp that comes in only when you need one or one that lives in with you? and why??
